How "Mathematics" take comot from ancient Islamic library – BBC

Wia dis foto come from, Getty Images
Di House of Wisdom (Bayt al-Hikmah) fit sound like tales by moonlight on top say dem destroy di ancient library for di 13th century.
But di academy wey bin dey for Baghdad during di Islamic Golden Age na wia modern mathematics concepts like di number zero and di modern day "Arabic" numerals bin from come.
Dem bin open di library for di private collection of caliph Harun Al Rashid for di late 8th century, before dem come transform am to public academy 30 years later.
And e public sotay im drag plenti pipo from all ova di world and wih different belief like Muslim, Jewish and Christian scholars to study for dia.
At di time di House of Wisdom bin dey second to none if you wan study about mathematics, astronomy, medicine, chemistry, geography, philosophy, literature and di arts.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wia dis foto come from, Getty Images
Tori be say dem destroy di House of Wisdom for di Mongol Siege of Baghdad for 1258 and throw plenti manuscripts inside di River Tigres sotay di ink make di water black.
Although many pipo no fit build am for mind say no be movie place lie di Citadel for Game of Thrones, di reality of am come from how e change how pipo dey learn about mathematics forever.
Wia dis foto come from, Getty Images
Jim Al-Khalili, a professor of physics for di University of Surrey tok say di scientific ideas discovery of di House of Wisdom na wetin dey important about di academy.
Apparently, if you tok about mathematics for Europe, one name na im you go hear, Leonardo da Pisa (born 1170), wey dem call Fibonacci afta im die.
Tori be say di Italian mathematician bin receive im basic education for Bugia for North Africa.
Before im come travel go di Middle East for im 20s because of di ideas im bin dey hear about from India.
So wen e come back to Italy, Fibonaaci come write di first book on di Hindu-Arabic (1,2,3) numeric system wey im call Liber Abbaci.
Wia dis foto come from, Getty Images
Di book wey comot for 1202 bin demonstrate how to use di numbers take do calculations wey dem fit use for business to calculate profit, weight and barter and interest. Before dat time European business men and teachers still dey use Roman numerals wey turn multiplication and division to heavy wahala (try to multiply MXCI by LVII!) on top di fact say dem bin no get zero.
Finobacci bin get ogbonge understanding of di way Muslim scientists bin dey calculate and find im advantages like, dia calculating formulas, decimal system and adia algebra.
In fact im book Liber Abbaci na almost copy and past of di algorithms of Al-Khwarizmi wey dem call di papa of algebra, wey im form from di word al-jabr wey mean "di restoring of broken parts".
And for 821 dem appoint Al-Khwarizmi as head librarian of di House Wisdom.
Wia dis foto come from, Getty Images
Al-Khalili say na im introduce di Muslim world ro decimal number system wey Leonardo da Pisa and odas like ma cari enta Europe.
And dis two highly acclaimed mathematicians wey di world dey celebrate collabo on top di back of di House of Wisdom with four hundred years between dem.
Al-Khalili argue say because of di association to Al-Khwarizmi mean say di House of Wisdom go fit be more of academy than library as plenti
Dis na as plenti scholars for di library bin work hard to make sure say whoever fit read go grab wetin dem write.
Wia dis foto come from, Getty Images
June Barrow-Green, professor of history of mathematics for di Open University for UK tok say di House of Wisdom na wetin give foundation to how di dey understand mathematics.
E bin show di history of mathematics on how humans bin start to use di tally system to calculate or record calculations before-before,
Wia dis foto come from, Getty Images
Dis year go make am 850 years since dem born Fibonacci and e fit mark di beginning of di end for Roman numerals.
For UK, dem don dey change traditional roman numeral clocks for school to digital for school on top fear say students no fit tell di time for analogue clocks.
Some regions of di world don comot am from road signs and official documents. Even Hollywood don comot am from dia sequel feem titles.
But even with all dis, England still make am compulsory say students suppose sabi read roman numerals from 1-100..
Many of us no go sabi wetin MMXX mean (2020 by di way).
We fit no understand Fibonacci for im famous number pattern wey be sequence wey dey start with one and continue with di addition of di two previous numbers wey don enta pop culture lie literature, feem and visual art and songs but dem no dey teach one of im biggest contribution.
And dat na di time wey im go Islamic palace library some thousand years ago, bring number knowledge wen Christendom dey intellectually in darkness.
And dat alone dey enough to scata di thinking say na Europe be di baba for mathematics.
Na BBC Future first to publish dis tori.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Scroll to Top