Wia dis foto come from, Nigerian Presidency/ Andrew Harnik/Getty Images
Nigeria don reject claims wey American President Donald Trump allege say widespread killing of Christians dey happun for di kontri as e declare am, "kontri of particular concern".
Di goment tok di denial for statement wey dem drop on Saturday morning.
For di statement, di Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Tuggar tok say oga Trump position no really gel wit wetin dey happun for ground for Nigeria.
E tok say, "we dey stay commited for our ginger to handle di kasala of extremism wey special interests dey fuel wey don help build di decay and division for kontris around di intersecting West African and Sahel regions".
E note say di US don be close ally and say, "di goment of President Bola Ahmed Tinubu go maintain laser focus and steadfast commitment to all partners wey believe in genuine peace, stability, freedom and democracy."
Na on Friday, Trump announce say e don place Nigeria as "kontri of particular concern".
Di US President tok say, "Di United States no fit stand dey look dis kain atrocities as dem dey happun for Nigeria and plenti oda kontris… We tanda ready, willing and able to save our Great Christian population wey dey around di world".
E torchlight say "Christianity dey face existential threat for Nigeria" as im insist say "thousands of Christians don dey killed".
Di US President tok say im don direct some members of Congress wey include, Rep. Riley Moore, and Rep. Tom Cole, plus members of di House Appropraitions Committee to torchlight di mata and give am back wetin dem find.
Dis designation as "kontri of particular concern" na one of di most serious labels wey Washington fit sama kontri under US law.
E dey allow dem to sama sanctions or oda diplomatic measures against kontris wey dem accuse say dem get severe violations of religious freedom.
According to di US Department of States, "Country of Particular Concern" (CPC) na designation by di Secretary of State for nation wey engage for severe violations of religious freedom under International Religious Freedom Act (IRFA) of 1998.
"Di U.S. believe say our responsibility na to provide information regarding di status of religious freedom worldwide so dat di international community fit identify and implement solutions to address challenges to religious freedom", US Department of States write for dia website.
According to di US, di International Religious Freedom (IRF) 'require annual review of di status of religious freedom worldwide and di designation of countries wey don "engaged for or tolerate serious violations of religious freedom" during di reporting period.
Dis serious violation fit include torture, bad treatment or punishment, long detention witout charges, abduction or detention, or oda denial of di right to life, liberty, or di security of pesin.
Nigerians don dey face religious and ethnic tensions for long. No wia dem don feel am pass dan for di northeast wia Islamist groups like Boko Haram and di Islamic State West Africa Province don dey attack and kill pipo for ova 10 years.
For Plateau and Benue states, hundreds of pipo don dey killed and dat one dey attributed to farmers and hearders gbas-gbos.
But dis no go be di first time Nigeria go enta dis kain list.
Di last time di US give Nigeria dis kain title na for December 2020 and na di Department of State run am.
Di accuse den be say di kontri dey participate or tolerate severe violations o religious freedon according to di International Religious Freedom Act.
But di Biden goment comot am for November 2021 although dem no tok why.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Content is not available
Meanwhile US Senator for Texas, Ted Cruz don hail di move by Donald Trump to label Nigeria as kontri of particular concerns.
Dis na as e claim say na im be di one wey carry legislation go senate to designate di kontri like dat and sama sanctions on Nigeria officials wey dey facilitate jihadist violence and enforce blasphamy lasws.
For statement e tok say, "I don dey fight for years against di slaughter and persecution of Christians for Nigeria and dis year I introduce legislation wey go lock in di designation wey bin dey made".
E explain say, "my legislation go add more steps like targeting di pipo wey dey implement blasphamy and sharia law for Nigeria and I dey committed to work wit di administraton and my colleagues to push my bill go front and implement dis necessary measures".
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.