Wia dis foto come from, Chip Somodevilla/Getty Images
President of di United States of America Donald Trump don declare Nigeria as kontri of particular concern.
E say dis na sake of how dem dey kpai 'thousands of Christians' for di kontri.
Trump tok dis one for post we e make for im Truth Social, wia e add say Christians for Nigeria dey face threat.
"Christianity dey face existential threat for Nigeria. Dem dey kill thousands of Christians. Radical Islamists dey responsible for dis mass slaughter."
"I dey hereby make Nigeria a 'country of particular concern' – but dat na di least of am."
Di US president say im don direct im congress pipo to look into di mata and make dem report back to am as dem no fit stand dey look dis kain 'attrocities' dey happun for Nigeria.
"Wen Christians, or any such group dey slaughtered liek e dey happun for Nigeria, sometin gatz be done."
"I dey ask Congressman Riley Moore, togeda wit Chairman Tom Cole and di House Appropriation Committee, to immediately look into dis mata, and report back to me."
According to di US Department of States, "Country of Particular Concern" (CPC) na designation by di Secretary of State for nation wey engage for severe violations of religious freedom under International Religious Freedom Act (IRFA) of 1998.
"Di U.S. believe say our responsibility na to provide information regarding di status of religious freedom worldwide so dat di international community fit identify and implement solutions to address challenges to religious freedom", US Department of States write for dia website.
According to di US, di International Religious Freedom (IRF) 'require annual review of di status of religious freedom worldwide and di designation of countries wey don "engaged for or tolerate serious violations of religious freedom" during di reporting period.
Dis serious violation fit include torture, bad treatment or punishment, long detention witout charges, abduction or detention, or oda denial of di right to life, liberty, or di security of pesin.
Na under dis category US President Trump bin place Nigeria sake of claim say dem dey kill Christians for Nigeria.
To be 'country of particular concern mean say di US fit impose some economic measures, if dem don use all di non-economic options finish, according to information wey dey available for di US Department of State website.
"Di President authority to designate country of particular concern dey delegated to di Secretary of State."
"For dose cases wia di Secretary of State designate CPC, Congress dey notified, and wia dem don finish di non-economic policy options wey dey designed to bring about stop to di particular serious violations of religious freedom, dem go impose economic measure generally," di website tok.
Wit dis, e mean say di US fit sanction Nigeria or impose some economic measures on di kontri.
Meanwhile for 29 December 2023, di Secretary of State bin declare Boko Haram as Entities of Particular Concern.
Entities of Particular Concern (EPC) na for non-state actors wey don engage for particular serious violations of religious freedom.
Di most recent 'Countries of Particular Concern' designations wey di US Secretary of State bin make na for December 29, 2023.
Di kontris include:
Since September 2025, Nigerian govment don stand say no religious genocide dey happun for di kontri.
Dem say dat kain claim na lie becos say no be only Nigeria dey face securiti challenges.
According to Honourable Minister of Information and National Orientation for Nigeria, Mohammed Idris, e say claims by some media and influencers say genocide against Christians na false.
"D Federal govment strongly condemns and categorically reject recent allegations by certain international platforms and online influencers wey suggest say terrorists wey operate for Nigeria dey engage for systematic genocide against Christians."
Di minister say to dey portray Nigeria securiti problem as campaign against one religion no be di reality for Nigeria.
"Di violent activities of terrorist groups no dey confined to any particular religious or ethnic community. "
E say add say Nigeria na multi-religious state wit large populations of both Christians and Muslims.
"Di Nigerian story no be one of religious genocide or persecution. We urge di international media and oda commentators to act wit responsibility and get respect for facts."
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *