Wia dis foto come from, ANGELA WEISS/AFP via Getty Images
Nicki Minaj – di US-based, multi-million-selling Trinidadian rapper – don publicly back President Donald Trump allegations say Christians dey face persecution for Nigeria.
"In Nigeria, Christians dey targeted," Minaj tok on Tuesday for one UN event organised by di US, come add say "Churches dey burn, families don tear finish … simply becos of how dem pray."
Dis dey follow recent threats by Trump to send troops to Nigeria "guns a-blazing" if di govment "kontinu to allow di killing of Christians".
But di Nigerian presidency say di widespread violence wey for long don dey worry di West African nation dey affect evribodi, regardless of background or belief.
Minaj, wey her real name na Onika Tanya Maraj-Petty, say calling for di protection of Christians in Nigeria "no dey about taking sides or dividing pipo,"but na about "uniting humanity".
"Dis na about standing up in di face of injustice. Na about wetin I always stand for," she add as she stand wit di US ambassador to di UN, Mike Waltz.
Di 42-year-old rapper thank Trump as e "prioritize dis issue and for im leadership".
She describe Nigeria as "a beautiful nation with deep faith traditions" and even acknowledge di "beautiful Barbz" – wey be her fans – for di West African country.
End of Di one wey oda users dey read well well
Waltz thank di rapper as she "use her massive platform to spotlight di atrocities against Christians in Nigeria".
For months, right-wing campaigners and politicians for Washington don dey allege say Islamist militants dey systematically target Christians in Nigeria.
But di BBC don find out say some of di data wey dem dey rely on to come to dis conclusion dey difficult to verify.
Deadly disputes often dey over vital resources like land and water or dey fueled by inter-ethnic tensions, rather than religion, some analysts tok.
Nigeria govment no deny say deadly violence dey di kontri. But say, "Terrorists dey attack evri pesin wey reject dia murderous ideology – Muslims, Christians and those of no faith alike".
Minaj previously name-check her fanbase, pipo sabi as di "Barbz", as a reason for her intervention, come tok online say: "di Barbz & I no go stand down in di face of injustice. We get our influence by God. Bigger purpose must dey."
Last year she publicly reveal say despite moving from her native Trinidad to New York for early age, she still neva get US citizenship.
Her appearance for di UN on Tuesday na her highest-profile political intervention to date.
She make headlines during di pandemic for sharing disinformation about side-effects of di Covid vaccine – claiming say wen a friend of her cousin bin get di jab, e cause im testicles to swell up and im come dey impotent.
"Im friend bin dey weeks away from getting married, now di girl don cancel di wedding," Minaj write online.
Her comments bin dey criticised by UK chief medical officer at di time, and di then-Prime Minister Boris Johnson also comment with joke say: "I no dey as familiar with di works of Nicki Minaj as I probably suppose dey."
In recent months, her years-long quarrel wit fellow New York rapper Cardi B escalate as dem insult dia sef about each oda careers and family members.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *